Officer Adamu And His Funky Boss ( Please Don't Laugh Out Loud)
Ogaa: Adamu how na?
Adamu: i dey fine, sir we don catch a bus with full of nigerian
musicians. But i
no know how i go take give them the price wey dem go pay
Oga: tell me their names and i go tell u their
price.
Adamu: okay eemm,, d'banj and 2face
Oga: thirty million naira each.. last.
Adamu: okay then naeto-c and banky w
Oga: twenty-twenty million naira last
Adamu: okay then wizkid, davido, olamide and
ice prince.
Oga: twenty-twenty million naira
Adamu: ehemm.. Then style plus.
Oga: who be that?
Adamu: the guys wey sing "four years don
wakka"
Oga: 25 thousand naira for the four of them.
Adamu: okay... Then Zaki
Oga: abeg speak english
Adamu: na him name be That... I no know am, but na
him sing
"DANKURA MARERI MATA"
Oga: adamu!! Give am money for transport, make him no vex... Na
so guys like him go just dey finish our food.. And we
no go gain
anything!!