Laugh Away Your Sorrow | A 1000% LAFF AFRICA

Laugh Away Your Sorrow

Null
• U dey carry ur girlfriend go club; after u marry her finish u wan stop her frm goin to club. My broda u think say miracle fit happen?

• Ur girlfriend dump u for rich man u say she b gold digger, bt ur sister do d same to anoda perso u giv testimony for Church
say, na grace of God. Bros park well!!
• Your babe get F9 parallel for WAEC, she still dey ask for Brazilian Hair of #150,000 . Abeg where she wan fix am?,
on top that coconut head?
• U have 8 tribal marks, stretch marks scattered all ova ur body yet u still want a tattoo...ah! my friend; u be zebra?!!
• U are 6 feet tall, u still com wear 6 inches high heeled shoe... shey u wan whisper to God?
• U dey snap inside different type of cars yet u expect ur man to believe say u no cheat. .aunty, u be mechanic?
• U gather different gals picture for ur fone & yet u xpect ur gal to believe say u no cheat.. uncle, u be photographer?
• He give u engagement ring for over five years, he never marry u, my dear, u be lord of d rings?
•you dey pay your babe wey dey university school fees and yet u never write JAMB, U be scholarship board?
•U are 18yrs and ur sugar daddy is 70yrs old and u still dey call am BABY, my sister, he suppose be ANCESTOR.
•Your babe is licking ice cream...u're drinking pure water...pls guy Are u diabetic?
•U claim say u eat rice and stew, but u come vomit fufu and egwusi soup. Omo u be magician? .
Na joke o....Read and pass on to friends make dem laugh too..
Null

Post a comment