Lol! One of my Guy just talk one funny thing now say, Since Him sister begin use BB phone, Say she never for One day do Subcription by herself (With her own money),, na im two of dese babes wey we dey with us, just laugh say "BEFORE NKO?, na Who Buy her the PHONE go dey RECHARGE /SUBCRIBE for am na"..
Hmmmm! All d Babe Rechargers here, I hail una oo.. Una know how much Airtime most babes dey get from d Numerous Guys wey dem dey get?.. Una know how much dey deir BankAccounts??,, Shey no be one Guy complain few hours ago say him see 42k for him babe Account?, Babe wey no dey work o!..
Hmmmm! Seriously! D fear of Most of our Today Ladies, is d Beginning of Great Wisdom..
Open your Eyes guys! Use your Brains!, Most babes no get Conscience again, ChaCha! Their eye dey Red!