Make una laff small | A 1000% LAFF AFRICA

Make una laff small

Null

I LOVE NAIJA I NO GO LIE!!! God Bless Nigeria!!! Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading N200 MTN Recharge Card.

Very soon Etisalat go say recharge N200 and win a big ship.
Then Airtel go com follow sey, recharge N100 and win Benin Republic.
Glo, go just kuku say... Recharge N500 and win Nigeria bcos their colour na Green.
Na only for Nigeria you go see fish inside"MEATPIE"
Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines.
Na only for Nigeria PHCN dey sey:-
Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (wat a pity)
Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green.
Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin,Puff puff and beer.
Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world...
Trust me. Na only 4 naija you go find a graduate of Mechanical Engineering dey do him NYSC 4 Police station.
na only 4 naija you go see one person dey use Bold5, X3, Ipad2 and Nokia N8 all at once.You be Bill Gates? Abi na you invent internet?
Na only 4 naija you go see a graduate of law dey work as generator repairer.
Na only for Naija u go buy coke, dem go say make u no forget to return d bottle.
Na 4 only Naija, you go see
madman dey control traffic,people wey their head correct dey
obey...
Na 4 only Naija, you go see advert from native doctor on how to make quick money.
Na only for Naija u go wish somebody 'happy birthday', he go answer 'same to u'.
Na 4 Naija obituary poster dem go say "MAMA HAS RELOCATED"
.. im proud of dis my country we dey unik.
I take God beg u to SHARE dis message to reach every body to love dis nation
Null

Post a comment